Week 6

Abeg share


LESSON TITLE: Faith for Action โ€“ Living Wetin You Believe


๐Ÿ“– MEMORY VERSE
Hebrews 11:6 (Pidgin Bible)
โ€œWitout faith, nobody fit make Baba-God happy. Anybody wey wan come near am must believe sey Baba-God dey, and sey e dey reward pipo wey serious dey look for am.โ€


Students repeat am 3 times:
I get faith.
I believe Baba-God.
Reward dey my way.


๐Ÿ“ LESSON AIM
By di end of dis lesson, we go sabi:
-Wetin faith mean.
-Why faith dey important.
-How faith dey work wit action.
-How faith dey epp pesin fulfill hin purpose for life.


๐ŸŒ LESSON INTRODUCTION
My pipo, faith no be wish.
Faith no be to dey do cho-cho-cho.
Faith na action based on trust.
Everi day, we dey believe sometin:
-We believe sey sun go rise.
-We believe say food go satisfy hunger.
-We believe say tomorrow go beta.


Faith in Baba-God mean say:

๐Ÿ‘‰ You trust am.
๐Ÿ‘‰ You believe am.
๐Ÿ‘‰ You act based on wetin e tok.
Faith dey move life forward becos e go make you do wetin you no go fit do normally wit ordinary eyes. Faith dey turn dream to reality and e go give you everitin wey you want.


๐Ÿ“– LESSON TEACHING


1๏ธโƒฃ Wetin Faith Mean
Faith na strong belief wey dey push you to act, even wen you neva see result.
Faith mean:
-Trust Baba-God word.
-Stand strong even wen condition hard.
-Move forward witout fear.

Example:
-Abraham believe Baba-God, con waka without map.
-David believe Baba-God, con face Goliath.
-Woman wey touch Jesus cloth get healing because of faith.
๐Ÿ‘‰ Faith no be waiting.
๐Ÿ‘‰ Faith na movement.


2๏ธโƒฃ Faith Must Get Action
James 2:17 tok say:
โ€œFaith without work no get life.โ€
If you believe:
-You go act.
-You go prepare.
-You go move.


Example:
Pesin wey believe sey exam go sweet, go read.
Farmer wey believe in harvest, go plant seed.
Christian wey believe Baba-God blessing, go obey and pray.
Faith wey no dey show for action no dey work.


3๏ธโƒฃ Faith Dey Open Purpose
Wen you live by faith:
-Fear go comot.
-Doubt go reduce.
-Purpose go show clear.
Faith dey epp you:
-Use your gift.
-Try new tins.
-Waka enta your calling.
๐Ÿ‘‰ Faith dey tok sey sey: โ€œI fit do am.โ€
๐Ÿ‘‰ Faith dey tok sey: โ€œBaba-God dey my back.โ€


4๏ธโƒฃ Daily Faith Practice

-Think big.
-Start your day wit prayer.
-Believe Baba-God promises.
-Tok faith words, no tok fear.
-Take small steps everi day.
-No give up when delay show.
-Small faith fit move big mountain.
-Consistent faith dey change destiny.


๐Ÿชž PRACTICAL APPLICATION FOR LIFE
Start everi morning by telling yoursef sey: โ€œBaba-God, I trust you today.โ€
-Act on wetin you believe.
-Use your talent witout fear.
-Try again even after failure.
-Ginger yoursef wit faith words.
-Faith dey grow wen you use am.


๐Ÿ“Œ Stop to dey tok sey:
โŒ โ€œI no sureโ€
โŒ โ€œI no fitโ€
โŒ โ€œMake I wait firstโ€


๐Ÿ“Œ Start to dey tok sey:
โœ… โ€œI believe Baba-Godโ€
โœ… โ€œI get faith to move forwardโ€
โœ… โ€œMy life dey go somewhereโ€


โ“ DISCUSSION QUESTIONS + ANSAS
Q1: Wetin faith mean?
โœ… Ansa: Faith na strong belief in Baba-God wey dey lead to action.
Q2: Why faith dey important?
โœ… Ansa: Faith dey make Baba-God body sweet am, e dey komot fear, and open door for blessings.
Q3: How faith dey work with action?
โœ… Ansa: True faith must show for wetin pesin dey do.
Q4: How faith dey epp purpose?
โœ… Ansa: Faith dey give courage to use gifts and follow calling.
Q5: Wetin go happun if pesin no get faith?
โœ… Ansa: Fear and doubt go stop progress, con delay purpose.


๐Ÿ—ฃ๏ธ WEEK SIX CONFESSION

โ€œBaba-God, I believe you.
I trust your word.
My faith dey alive wit action.
Fear no get pawa over me.
I dey waka inside purpose.
My steps dey correct kamkpe.
Good tins dey my way. Amen.โ€


๐Ÿ“Œ TEACHER NOTE
Explain sey faith na lifestyle, no be emergency tool.
Encourage students to practice faith everiday.
Use real-life examples to show faith inside action.
Remind dem say faith plus obedience dey work togeda.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Support us if you know sey you enjoy dis Pidgin Sunday School. Your donations go epp us print di hard copy.ย  Click here.