Week 8

Abeg share


LESSON TITLE: Wisdom for Living Everiday– Making Correct Choices


📖 MEMORY VERSE

Proverbs 4:7 (Pidgin Bible)
“Wisdom na di main tin. If you wan get anytin, make you get wisdom. Wit all wetin you get, make sure sey you get understanding.”


Students repeat am 3 times:
-I get wisdom.
-I dey always make correct choice.
-My life dey safe.


📝 LESSON AIM
By di end of dis lesson, we go sabi:
-Wetin wisdom mean.
-Difference between wisdom and knowledge.
-Why wisdom dey important for life.
-How to apply wisdom everi day.


🌍 LESSON INTRODUCTION
My pipo, knowledge dey plenty, but wisdom no dey common.
Pesin fit sabi book, but still make wrong choice.
Wisdom na wetin dey epp pesin use hion common sense.
Everi day, life dey bring choices:
-Good or bad.
-Right or wrong.
-Now or later.
Wisdom na di ability to choose well and do wetin go epp you or odas.


📖 LESSON TEACHING


1️⃣ Wetin Wisdom Mean

Wisdom na ability to use knowledge correctly.
Wisdom mean:
-To use wetin you don learn and to think before you act.
-To learn from experience.
-To fear Baba-God.


Example:
-Solomon ask Baba-God for wisdom.
-Wise builder build house on rock.
-Foolish builder build on sand.
👉 Wisdom dey save life.


2️⃣ Wisdom Pass Knowledge
Knowledge tell you wetin to do.
Wisdom tell you wen and how.
Example:
Knowledge sey fire hot.
Wisdom sey no touch am.
Knowledge sey money good.
Wisdom say manage am well.
👉 Wisdom dey prevent regret.


3️⃣ Wisdom Dey Protect Destiny
Many pipo spoil destiny becos of wrong choices. Some pipo no dey patient for life, some pipo no fit sacrifice dia moni or time for sometin wey dem go gain from lata.
Wisdom dey epp you:
-Choose correct friends.
-Avoid kasala.
-Make long-term decisions.
Example:
-Wise student choose good company.
-Wise worker avoid shortcut.
-Wise believer listen before acting.


4️⃣ How to Grow Wisdom Everiday
-Pray for wisdom.
-Read Baba-God word.
-Listen to advice.
-Learn from mistake.
-Think before you tok.
Wisdom dey grow wit humility.


🪞 PRACTICAL APPLICATION FOR LIFE
Start everi day bytelling yoursef sey: “Baba-God, give me wisdom today.”
-Calm down to make decision.
-Ask questions.
-Choose peace instead of pride.
-Think of tomorrow.
One wise decision fit change whole life.


📌 Stop to dey tok sey:
❌ “I no care”
❌ “Anytin fit happen”
❌ “I go manage am”


📌 Start to dey tok sey:
✅ “I dey think well”
✅ “I dey choose right”
✅ “My destiny dey safe”


❓ DISCUSSION QUESTIONS + ANSAS
Q1: Wetin wisdom mean?
✅ Ansa: Wisdom na ability to apply knowledge correctly.
Q2: Wetin be di difference between wisdom and knowledge?
✅ Ansa: Knowledge na wetin you know; wisdom na how you use am.
Q3: Why wisdom dey important?
✅ Ansa: Wisdom dey protect life, destiny, plus future.
Q4: How person fit grow wisdom?
✅ Ansa: Tru prayer, reading Bible, listening to advice, and learning.
Q5: Wetin fit happen if pesin no get wisdom?
✅ Ansa: Wrong choices fit lead to regret and loss.


🗣️ WEEK EIGHT CONFESSION
“Baba-God, I receive wisdom.
-My mind dey sharp.
-I deymake correct choices.
-I no go always calm down to make good decision.
-My life dey guided.
-My destiny dey protected. Amen.”


📌 TEACHER NOTE
Use real-life scenarios take explain wisdom.
Encourage students to think before acting.
Teach difference between wisdom and intelligence.
Remind dem say wisdom dey start with fear of Baba-God.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Support us if you know sey you enjoy dis Pidgin Sunday School. Your donations go epp us print di hard copy.  Click here.