Week 1
LESSON TITLE: Who Be Baba-God? (Baba-God Na Di Creator)
📖 MEMORY VERSE
Genesis 1:1
“For beginning, Baba-God create heaven plus earth.”
📝 AIM Of LESSON
By di end of dis lesson, we go sabi:
-Sey Baba-God na di Creator of heaven plus earth.
-Sey we carry Baba-God image.
-Sey creativity na Baba-God first character.
-How to use awa mouth take create good tin for life.
– 📚 MAIN BIBLE PASSAGES
Genesis 1:1–5
Genesis 1:26
Genesis 2:15
🌍 LESSON INTRODUCTION
My people, before man waka for dis earth, before sun shine, before water flow, Baba-God don already dey.
-Baba-God no learn from anybody.
-Baba-God no dey copy anybody.
-Baba-God no dey rush.
-Na Baba-God create everitin.
-Na Baba-God imagine everitin before e appear.
-Na Baba-God tok, and everitin obey am.
Today, we wan learn who Baba-God be and why we suppose dey creative like am.
📖 LESSON TEACHING
1️⃣ Baba-God Na Di Original Creator
Genesis 1:1 tok sey:
“For beginning, Baba-God create heaven plus earth.”
Dis one mean say:
Baba-God dey first, everitin dey follow.
Notin dey above Baba-God.
Baba-God start everitin.
👉 If Baba-God dey before everitin, then notin fit surprise awa life.
2️⃣Creativity Start For Mind, Then Mouth
Before Baba-God tok about light, e dey for Hin mind first.
Den Baba-God tok am wit mouth, and light show-face.
Na di same way e dey for awa life:
First, imagine di good tin,
Den, tok am wit mouth. no fear.
Den, e go appear for your life
Hebrews 11:3 tok sey:
“Na by faith we sabi sey Baba-God use words take create di world.”
3️⃣ Baba-God Create From Notin
Genesis 1:1 no tok sey:
Baba-God fix old world, or sey Baba-God manage wahala.
👉 Baba-God create everitin from notin.
If Baba-God fit create heaven plus earth from notin, notin too small or too hard for awa life.
4️⃣ Baba-God Make us Creators like am.
Genesis 1:26 tok sey:
“Make we create man for awa image, make dem rule over di earth.”
Genesis 2:15 tok sey:
“Baba-God put man for garden make e work am and take care of am.”
Dis one mean sey:
-Baba-God create di world.
-We suppose kontinu di work.
-We suppose use creativity bless di world.
5️⃣ Creativity Na First Character wey Baba-God Show
Before love, before mercy, before judgment — creativity first show.
Baba-God imagine di world before e appear.
Baba-God tok am, and everitin obey am.
👉 Creativity na part of awa image.
We suppose dey creative too.
6️⃣ Power of Words
Baba-God no just imagine; e tok. As Baba-God create di world wit words, awa mouth sef fit create tin and make beta tins happun for awa life.
Proverbs 18:21 tok sey:
“Death and life dey for pawa of mouth.”
If we tok bad, bad go show. If awa tok good, good go show. Words na seed, life na ground.
🪞 PRACTICAL LIFE APPLICATION
Use your mind take imagine good tins.
Use your mouth tok life, blessing, plus progress.
Stop to dey tok negative and yama-yama tins we no make sense for your life.
Start to dey tok sey:
✅ “Baba-God dey work good for me”
✅ “My future bright”
✅ “Good tins dey come”
📌 Stop to dey tok sey:
❌ “I no dey creative”
❌ “My words no mean anytin”
❌ “I no get anytin”
📌 Start to tok sey:
✅ “Baba-God don put creativity inside me”
✅ “I fit create sometin from notin”
✅ “Baba-God dey inspire me to create new tins everiday”
❓ DISCUSSION QUESTIONS + ANSAS
Q1: Who create heaven plus earth?
✅ Ansa: Baba-God create everitin.
Q2: Why we be co-creators?
✅ Ansa: Baba-God create us inisde Hin image, con give us authority for di earth.
Q3: Wetin be di first character wey Baba-God show?
✅ Ansa: Creativity.
Q4: How our mouth fit affect life?
✅ Ansa: Our mouth fit create good or bad tins wit words.
Q5: Wetin Genesis 1:1 teach us?
✅ Ansa: Sey Baba-God dey before everitin and na Him start everitin.
🗣️ WEEK ONE CONFESSION
“For beginning, Baba-God create heaven plus earth.
Baba-God create me inside Hin image.
I be creator like Am.
Creativity dey for inside me.
My mouth go create good tins forever.
My world dey beta everiday.”
📌 TEACHER NOTE
-Seriously let dem know sey awa creativity na part of Baba-God image.
-Words no be joke.
-Everi idea wey we imagine fit appear if we add faith plus tok, plus action.