Week 3

Abeg share

LESSON TITLE: Sin, Choice, and Free Will – How Your Choices Dey Affect Your Life


📖 MEMORY VERSE

Genesis 3:6-7 (Pidgin Bible)
“Di woman see sey di tree fine, e good for food, and e sweet for eye, she take di fruit, chop am, con give her husband. Dem chop am togeda. Den dem sabi sey dem dey naked, and dem fear.”


📝 LESSON AIM
By di end of dis lesson, we go sabi:
1. Wetin sin be and how e start.
2. Wetin free will and wetin choice mean.
3. Understand di result of wrong plus right choices
4. Learn how to obey Baba-God and follow purpose.


🌍 LESSON INTRODUCTION
My pipo, after Baba-God create man and woman, Baba-God put dem for garden con give dem freedom.
Dem fit chop anytin.
Dem no fit chop only one tree.
Dis na di first test for free will.
Free will na Baba-God gift wey allow us choose.
Everi day, weget choices.
Everi day, awa mouth and hand dey decide blessing or wahala.


📖 LESSON TEACHING


1️⃣ Wetin Sin Be

Genesis 3:6-7 show say:
Woman chop fruit wey Baba-God no allow
Man chop sef.
Dem sabi sey dem dey naked and shame enter dem. Sin na disobedience. Na to go against Baba-God instruction. To choose self above Hin will
👉 If you sabi purpose but disobey, life go mix up.


2️⃣ Free Will and Choice
Baba-God no force man to obey.
Baba-God put law and instruction, but man get freedom to choose.
Choice fit bring blessing.
Choice fit bring trouble.


Example for today:
Choice to study or waste time.
Choice to speak truth or lie.
Choice to epp odas or to dey selfish.
Every choice dey important.


3️⃣ Consequences of Choice

Genesis 3:16-19 show consequences:
Woman face pain for childbirth
Man go dey sweat for food
Life go get wahala because dem choose wrongly
Psalm 1:1-2 tok sey:
“Blessed be di pesin wey dey follow Baba-God law, wey no dey waka wit sinners. And wetin dey make body sweet am na Baba-God word.”
Wrong choice dey bring trouble.
Right choice dey bring blessings.


4️⃣ Obedience Na Protection
-Baba-God instruction no dey to block us.
-Instruction dey protect us, guide us, con make life beta.
-Obey Baba-God for small tins.
-Obey Baba-God for big tins.
-Obedience dey connect purpose plus blessings.


5️⃣ Finding Life Purpose Wit Choices
-Everi choice dey affect awa life purpose.
-If you obey, your life go confam.
-If you disobey, your life go suffer.


Example:
-Choosing to learn skills dey fulfill purpose.
-Choosing laziness dey waste potential.
-Choosing kindness dey reflect Baba-God image.
-Choosing selfishness dey destroy life blessing.
👉 Make students sabi say life get meaning if we dey conscious of choices


🪞 PRACTICAL LIFE APPLICATION
-Think before you act.
-Ask Baba-God for guidance.
-Choose words wey dey build life.
-Avoid temptation wey go destroy life.
-Everi choice dey shape future plus destiny.


📌 Stop to dey tok sey:
❌ “I no sabi choose”
❌ “I no-send”


📌 Start to dey tok sey:
✅ “I go choose right today”
✅ “I dey follow Baba-God instruction”
✅ “My choice go bring blessing”


❓ DISCUSSION QUESTIONS + ANSAS
Q1: Wetin sin mean?
✅ Ansa: To go against Baba-God instruction or choose wrongly.
Q2: Wetin free will mean?
✅ Ansa: Baba-God give us pawa to choose between right or wrong.
Q3: Wetin happun if pesin dey disobedient?
✅ Ansa: Wahala, suffering, and life no go reach full purpose.
Q4: How pesin fit protect life from bad consequences?
✅ Ansa: Obey Baba-God, think before you act, and make right choices.
Q5: How your choices dey affect purpose for life?
✅ Ansa: Right choices dey fulfill purpose, wrong choices dey waste life blessing.


🗣️ WEEK THREE CONFESSION
“Baba-God give me choice.
I go choose right things today.
I go obey Baba-God instruction.
I dey conscious of my words and actions.
I dey follow my life purpose.
I dey creative, I dey productive, I dey bless others. Amen.”


📌 TEACHER NOTE
-Seriosuly tok about how choice take dey powerful.
-Encourage students to think about result before action.
-Show sey obedience + conscious choice dey epp purpose manifest
-Remind dem sey Baba-God always dey guide.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Support us if you know sey you enjoy dis Pidgin Sunday School. Your donations go epp us print di hard copy.  Click here.