Week 2
LESSON TITLE: Why Baba-God Create Man (Purpose, Take-control & Meaning for Life)
📖 MEMORY VERSE
Genesis 1:26-28 (Pidgin Bible)
“Make we create man for awa image, make dem rule over di fish, di bird, di animals, and di whole earth. Baba-God bless dem, talk say: ‘Multiply, dey plenty, fill di earth, and rule am well-well.’”
Students repeat am 3 times:
Baba-God bless me. Baba-God give me work. I dey ruler of di earth.
📝 LESSON AIM
By di end of dis lesson, we go sabi:
-Why Baba-God create man.
-Understand “rule over di earth” (dominion).
-Understand purpose and meaning for life.
-How to apply dominion, creativity, and stewardship everi day.
📚 MAIN BIBLE PASSAGES
Genesis 1:26–28
Genesis 2:15–17
Psalm 8:4–8
🌍 LESSON INTRODUCTION
My pipo, afta Baba-God create heaven, earth, sun, water, and evertin, Baba-God con tok sey:
“Make we create man for awa image.”
Na sign sey man no be accident. Man no just dey like Dat. Man get purpose.
Everi pesin get reason why dem dey alive. If you no sabi your purpose, life fit look empty. If you sabi your purpose, life go brekete wit meaning, your waka go dey important, and everitin wey you do go count.
📖 LESSON TEACHING
1️⃣ Baba-God Create Man for His Image
Genesis 1:26 tok sey:
“Make we create man for awa image.”
Meaning:
-Awa nature fit show Baba-God face.
-Awa creativity na like Baba-God creativity.
-Awa wisdom, love, and spirit dey inside us.
👉 If you sabi sey you carry Baba-God image, you go respect yoursef, respect odas, con dey creative.
2️⃣ Dominion Over Di Earth
Genesis 1:28 tok sey:
“Rule over di fish, di bird, di animals, plus di whole earth.”
Dominion (take-control) no mean sey make you dey oppress.
Dominion mean care, manage, protect, arrange, and improve.
Example:
Farmer dey rule farm by planting, watering, protecting crops.
Teacher dey rule classroom by guiding and teaching students.
Parent dey rule children by training dem.
Dominion mean work + responsibility + blessing.
3️⃣ Multiply and Fill Di Earth
Genesis 1:28 tok sey:
“Multiply, dey plenty, burku for di earth.”
Life no suppose stop. Growth and progress dey everiwhere. Everi pesin get work to do, small or big.
👉 If you no sabi your purpose, life fit be like sey e dey empty.
👉 If you sabi purpose, everi day go dey get meaning for you.
4️⃣ Stewardship: Care of Di Garden
Genesis 2:15 tok sey:
“Baba-God put man for garden make e work am and take care of am.”
Stewardship mean manage, protect, improve everitin wey Baba-God give you.
-Life na garden
-Your body na garden: Take care of your health, chop beta food and do exercise everi time.
-Family na garden: Show love to your family and take care of dem.
-Gifts na garden: Value any gift wey Baba-God or pipo give you. Show appreciation.
-Environment na garden; Take care of di area wey you dey stay. Care for nature plus your environment and make sure sey e dey clean.
5️⃣ Obedience Na Key
Genesis 2:16–17 tok sey:
“You fit chop di fruit from all di trees, but di tree of knowledge of good and evil, no chop am or you go die.”
Purpose get limits plus guidelines.
Obedience dey show respect for Baba-God plan.
Obedience dey keep you from harm.
6️⃣ Finding Your Purpose
Baba-God no create anybody for waste.
You get reason to dey alive.
Purpose fit be:
-Serving Baba-God.
-Helping people.
-Using talent, gift, or skill to bless life.
-Growing yourself plus community.
-Bringing peace, love, and truth
If you sabi wetin you go live for, life go get meaning and life go sweet, your action go count, and your days go dey fruitful.
Psalm 8:4–8 remind us sey:
“Baba-God give man high place pass di animals, birds, plus everi living tin.”
Dis na sign sey man get responsibility and honor.
Find purpose mean sey you sabi wetin Baba-God want make you do.
🪞 LIFE APPLICATION
-Discover your gifts, talents, and passion.
-Ask Baba-God for direction daily.
-Use your creativity for good things.
-Care for life, family, environment, plus community.
-Speak life plus blessings on yoursef.
-Obey Baba-God instructions.
📌 Stop to dey tok sey:
❌ “Life no get meaning”
❌ “I no sabi wetin I go do”
📌 Start to tok sey:
✅ “Baba-God make me for purpose”
✅ “I sabi wetin I go live for”
✅ “My life dey important, and I go bless odas”
❓ DISCUSSION QUESTIONS + ANSaS
Q1: Why Baba-God create man?
✅ Ansa: To reflect Him image, to rule di earth, and to continue Him work.
Q2: Wetin dominion mean?
✅ Ansa: To manage, protect, and improve everything Baba-God give you.
Q3: Wetin multiply and fill di earth mean?
✅ Ansa: Life suppose grow, blessings suppose spread, and humans suppose continue Baba-God creation.
Q4: Wetin stewardship mean?
✅ Ansa: To care for and manage everitin wey Baba-God put under your responsibility.
Q5: Why obedience dey important?
✅ Ansa: Becos obedience dey show respect for Baba-God plan and keep us from harm.
Q6: How pesin fit fyne purpose for life?
✅ Ansa: By asking Baba-God, discovering gifts and talents, and using dem to bless yoursef plus odas.
📌 TEACHER NOTE
-Seriously tok about as awa life take get meaning because Baba-God give us purpose
-Encourage students to find wetin dem sabi do well and start using am.
-Words, obedience, creativity, and dominion dey go hand in hand wit purpose