Week 4

Abeg share

LESSON TITLE: Faith plus Trust – To Dey Waka Wit Baba-God everi day.


📖 MEMORY VERSE
Proverbs 3:5-6 (Pidgin Bible)
“Trust Baba-God wit all your heart. No depend on your own understanding. For everitin wey you dey do, remember am, and e go make your way straight.”


Students repeat am 3 times:
I go trust Baba-God. I no go depend on my mind. Baba-God dey guide my path.


📝 LESSON AIM

By di end of dis lesson, we go sabi:
-Wetin faith mean.
-Wetin trust mean.
-How to waka wit Baba-God everi day.
-How faith dey connect to purpose plus blessings.


🌍 LESSON INTRODUCTION
Faith na believe for wetin you neva see wit your korokoro eyes.
Trust na confidence sey Baba-God dey work, even if wahala dey.
Everi day, we dey face choices, challenges, fear plus wahala.
Every day, we dey decide to depend on awasef or Baba-God.
To waka wit Baba-God everi day dey bring blessing, protection, plus guidance.


📖 LESSON TEACHING


1️⃣ Wetin Faith Mean
Faith na believe say Baba-God fit do wetin e tok.
Hebrews 11:1 tok sey:
“Faith na confidence for wetin we dey hope, and di proof be sey we neva see wetin we dey hope for .”
Faith dey make impossible tins possible.
Faith dey connect us to Baba-God pawa.
Faith dey start for mind + heart.
Example:
Noah build ark before rain come.
Abraham trust Baba-God for promise land
Jesus waka on water.
👉 Faith dey show sey we dey depend on Baba-God, no be just only wetin awa eyes dey see.


2️⃣ Wetin Trust Mean
Trust na believe sey Baba-God go do wetin e promise, no mata di wahala.
Trust no dey depend on situation.
Trust no dey depend on pipo.
Trust dey depend on Baba-God character.
Psalm 37:5 tok sey:
“Commit your way to Baba-God. Trust am, and e go run tins for you.”
Trust dey make decisions easy.
Trust dey calm fear.
Trust dey make way straight.


3️⃣ Waka Wit Baba-God Everi day

To waka wit Baba-God mean:
-Tok to Baba-God every day (Prayer).
-Read di Bible daily (Di Word dey guide).
-Obey Baba-God instructions (Faith for action).
-Trust Baba-God even for wahala.
-Use creativity and gifts for good tins.
-Daily waka dey make faith strong.
-Daily waka dey increase trust.
-Daily waka dey connect purpose to blessing.


4️⃣ Faith + Trust + Purpose = Life Full of Meaning
Wen you:
-Believe Baba-God (faith).
-Depend on Baba-God (trust).
-Obey Baba-God (waka daily)
-Use your gifts plus talents
Den:
Life dey get purpose.
Life dey productive.
Life dey bless odas.
Life dey brekete wit joy.


🪞 PRACTICAL LIFE APPLICATION

-Start everi day wit prayer: “Baba-God, I dey trust you today.”
-Speak blessing fir your life: “I go dey guided, I go dey protected, I go dey fruitful.”
-Obey small instruction and see results
-Face challenges wit faith, no fear
-Waka wit Baba-God for school, house, work, and relationships.


📌 Stop to dey tok sey:
❌ “I no sabi wetin go happen”
❌ “I go try my own way”


📌 Start to dey tok sey:
✅ “I dey trust Baba-God”
✅ “I dey follow Baba-God instruction”
✅ “My faith dey strong, my way dey straight”


❓ DISCUSSION QUESTIONS + ANSAS

Q1: Wetin faith mean?
✅ Ansa: To believe sey Baba-God fit do wetin e promise, even if you no see am wit your korokoro eyes.
Q2: Wetin trust mean?
✅ Ansa: Confidence sey Baba-God go act, no mata di wahala.
Q3: How pesin fit waka wit Baba-God daily?
✅ Ansa: By prayer, reading Bible, obeying, trusting Baba-God, and using gifts well.
Q4: How faith + trust dey affect purpose?
✅ Ansa: E dey connect purpose to blessing and e dey make life get meaning.
Q5: Wetin go happen if pesin no trust Baba-God?
✅ Ansa: Pesin go dey fear, make wrong choices, and life go dey empty.


🗣️ WEEK FOUR CONFESSION

“Baba-God, I dey trust you wit all my heart.
I go follow your instruction everi day.
I dey waka wit you everi day.
My faith dey strong, my path dey straight.
I dey creative, I dey productive, I dey blessing odas .
My life get purpose con brekete wit meaning. Amen.”


📌 TEACHER NOTE
-Seriously tok about how faith and trust dey connect life to purpose.
-Ginger students to waka wit Baba-God daily, small-small obedience dey mata.
-Remind students sey faith + trust = protection, guidance, blessing, and fruitful life.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Support us if you know sey you enjoy dis Pidgin Sunday School. Your donations go epp us print di hard copy.  Click here.