Week 9
LESSON TITLE: Self-Control – Mastering Yourself to Secure Your Future
📖 MEMORY VERSE
Proverbs 25:28 (Pidgin Bible)
“Pesin wey no get self-control be like city wey e wall don kpafuka—anytin fit enta.”
Students repeat am 3 times:
-I get self-control.
-I control my body and mind.
-My future dey safe.
📝 LESSON AIM
By di end of dis lesson, we go sabi:
-Wetin self-control mean.
-Why self-control dey important.
-Areas of life wey need self-control.
-How self-control dey protect destiny.
🌍 LESSON INTRODUCTION
My pipo, di biggest fight no be against pipo—
na against yourself.
Many pipo get talent but dem no get control.
Many pipo get opportunity but dem spoil am.
Self-control na di pawa to sey NO to temptation
and YES to your future.
If you fit control yourself, you fit control your destiny.
📖 LESSON TEACHING
1️⃣ Wetin Self-Control Mean
Self-control na dei ability to manage:
-Your mouth.
-Your emotion.
-Your desire.
-Your action.
Self-control mean:
-No tokeverything wey come mind.
-No act based on anger.
-No follow body instead of sense.
Example:
-Joseph fashi Potiphar wife.
-Jesus resist temptation.
Wise pesin hold tongue.
👉 Self-control na strength, no be weakness.
2️⃣ Areas Wey We Need Self-Control
Self-control dey needed for:
-Yarning– wetin you dey tok.
-Chop-Chop– wetin and how you dey chop.
-Emotion – anger, jealousy, fear.
-Relationship – boundaries (dey your dey).
-Money – spending and saving.
-No control = regret.
3️⃣ Self-Control Protect Destiny
One wrong action fit destroy many years of hustle.
Self-control dey epp you:
-Avoid shame.
-Maintain respect.
-Keep focus.
-Secure future.
Example:
Pesin wey control anger dey avoid fight.
Student wey dey control distraction dey pass exam.
Leader wey dey control hin desire dey keep honor.
4️⃣ How to Build Self-Control Daily
-Pray for strength.
-Think of di result before action.
-Avoid bad influence.
-Practice discipline.
-Learn to hustle now and chop lata.
Self-control dey grow with practice.
🪞 PRACTICAL APPLICATION FOR LIFE
Start everi day toking sey: “Baba-God, help me control mysef today.”
-Calm down before you react.
-Waka komot from temptation.
-Choose peace.
-Remember your future.
Short pleasure no worth long regret.
📌 Stop to dey tok sey:
❌ “Na so I be”
❌ “I no fit epp am”
❌ “Make e happun”
📌 Start to dey tok sey:
✅ “I get control”
✅ “I dey think before I act”
✅ “My future dey important”
❓ DISCUSSION QUESTIONS + ANSWAS
Q1: Wetin self-control mean?
✅ Answa: Self-control na ability to manage your thoughts, words, plus actions.
Q2: Why self-control dey important?
✅ Answa: E dey protect destiny con komot regret.
Q3: Which areas need self-control?
✅ Answa: Speech, emotion, chop-chop, relationship, plus money.
Q4: How pesin fit develop self-control?
✅ Answa: Tru prayer, discipline, thinking ahead, plus practice.
Q5: Wetin happun if pesin no get self-control?
✅ Answa: E fit lead to shame, loss, and future wey don bend.
🗣️ WEEK NINE CONFESSION
“Baba-God, I receive strength to control myself.
-I no be slave to my desire.
-I dey disciplined and focused.
-My actions dey wise.
-My future dey protected.
-I go finish strong. Amen.”
📌 TEACHER NOTE
Explain sey self-control na fruit of di Spirit.
Use real-life examples students relate to.
Ginger accountability.
Remind dem sey control today secure tomorrow.